Friday, April 8, 2016

HMMM... SEE NUMBA WEY SUPER EAGLES DEY NOW FOR AFRICA AND THE WORLD

Super Eagles of Naija don fall reach 67th for the full world as dem get 532 points for the ranking of National team wey dem FIFA just release for April. Na 62 dem bin dey before for March, but as Naira don fall, wey Megawatt dey fall,  na so Super Eagles too fall  to 67 for world. For Africa, na Eagles dey number 14 for back of Ghana, Algeria, Cape Verde, Tunisia, Congo Democratic Republic plus Senegal. Na Algeria point high-pass for Africa as dem don move from  37th to 33rd for the world. Na 34th position, African champions Cote d'Ivoire dey as dem carry 2 steps forward. But Sha o, na Argentina dey lead the full world now as dem commot from number 2 wey dem bin dey before and na Belgium dey number 2 now.

No comments: