Saudi billionaire, Turki Bin Abdullah with him Padis dem, go show dem levels for West London when dem carry 4 cars wey dem do with gold go chop life for London. Afta dem don parade Kensington Street with dem badt cars, wey be Lamborghini Aventador, Mercedes G63 6×6, Bentley Flying Spur plus Rolls Royce dem come Park am for Cadogan Place, one street wey dey for Belgravia, London near Jumeirah Carlton Tower Hotel. CNN say the cars cars money go be like 1.8 million dollars, Dat na around 358 million Naira. (see more pinshures afta the cut)
No comments:
Post a Comment