Tuesday, April 12, 2016

ANODA GBEGE FOR LINDA IKEJI AS KEMI OLUNLOYO DON OPEN HER SECRET

Social media person, Kemi Olunloyo don start to dey para again O and dis time na inside Linda Ikeji compound her yabis plane for land. She say na Linda scatter her cousin and her Guy, popular OAP, Dan Foster. Ms Olunloyo for one interview say she don get plenty history with Linda O,  one of dem be say  na Linda scatter her cousin wedding to Dan Foster. She say Dan Foster and her cousin, Deola Olunloyo bin wan marry, even na 3 weeks to the wedding dem cancel am, because of one model, wey be  Linda Ikeji cos she shey run package with Dan. She still say Linda na 41 -years -old and no be 35 wey she dey claim on top Wikipedia. She say she sure die and if she no get fact ni,  she for no tall. But Linda Neva talk sha. Nawa O. Na who Linda come offend like Dat?

No comments: