Sunday, March 27, 2016

YEYE... SEE WETIN TOKE MAKINWA TALK ABOUT HER MARRIAGE




MISS SIMPLICITY - Toke Makinwa wey her marriage wit Maje Ayida bin kick rock some months ago sake of sey d guy bin give anoda person belle wey born for ham outside d marriage don com start to dey give ladies advice abt marriage o... She tok sey even tho many pipu go dey think sey she fall their hand on top sey her marriage no work, she no go bcos of dat one no advice pipu again. 


She even tok sey she bin dey shame to advice pipu afta her marriage scatter bt now she no shame again o on top sey she don come learn many tins abt life nd she sey she feel sey na her duty to advice oda ladies make dem for no fall enta wrong hand o.... Finally finally Toke advice ladies sey make dem dey look well before dem jump o, that is to sey make dem find time know their guy before dem open mouth tok sey Yes I do.... Hmmmm...thank u ma'am Toke Makinwa, we go try follo ur advice.....

No comments: