You suppose don Sabi say we no dey do byday hailing on top TPN, except say anoda thing join. Na so e still be today O, cos one of the Mama of pidgin presentation for Radio for Naija wey dey run things with Space FM 90.1, Ibadan dey do her byday today.
Doris Kehinde Amineshi na him be her real name as per say she be twins, and she dey over happy today as she don chop anoda years for God neck. The Edo babe plus her twin sister, her Taiye dey hail Baba God today for this kain opportunity say den see anoda year. We for TPN join Doris say thank God and we wish dem happy byday.
No comments:
Post a Comment