Sunday, March 27, 2016

AGAIN???... SEE WETIN WAN CARRY SEGUN ARINZE TOO TO PRISON






MISS SIMPLICITY - Segun Arinze nd co must beg me if not na kirikiri dem go take see demselves.....Emeka Ike. Dem just make Emeka Ike d new presido for AGN nd d guy don tok for one interview sey him victory o no get anytin to do wit d problem wey Ibinabo wey be d former AGN presido dey face o. 


He still com tok sey Segun Arinze nd many of their colleagues dey go press go dey yarn okpata sey na him send Ibinabo go jail. He don tok sey pipu dey threatened ham on top d post bt him no dey fear anybody, he sey him dey wait dem make him for fit tell dem sey dem be bad pipu. Emeka Ike don tok sey him go jail those pipu if dem no come beg ham o bcos e don tey wey dem don dey tok bad abt ham for everywhere...On top d Ibinabo mata wey she dey face for court, Emeka Ike don clear matas sey him no get hand for inside o, he com still ask sey abi na him be Giwa family or Government? Hmmmm.......

No comments: