Sunday, March 6, 2016

WE BIBLE PASSAGE FOR TODAY FROM THE PIDGIN BIBLE OB'S VERSION.

OGINI BERNARD -  MARK 13:24-32
Jesus yarn give hin disciples, dat time after kasala Don happen, d sun light go low, d moon go dull, d stars go begin fall n d power 4 heaven go dey shake.  Den dem go con see man pickin go show 4 cloud with hin power, he go send hin angels make hin gather people wey hin elect frm all d wings, frm earth go reach heaven.  Take orange tree 4 example, as d oranges come out n d leaves dem, u know say na to pluck, drink na hin remain, so wen u see dis kin thin dey happen, know say I don show 4 gate. 

I tell una 4 low key, before dis generation wipe, all dis thins 4 Don happen. Heaven go Come go, earth go show sef hin go go, but my yarnings n my lecture no go ever fade.  But 4 dat time wey dey come,  nobody sabi, even sef d angels no know, me sef no know, na only my papa know.  NB not for fun. Share to ur loved ones. God bless you. Happy Sunday.

No comments: