Oya na..... Dayo Amusa plus Dremo go bombard Filmhouse Cinema wey dey Ibadan today. Na Lagelu FM dey carry dem come totori dem fans for Ibadan. Tori yarn us say plenty faaji things na him dem go do.
Dem go watch film, snap pinshure, ask questions plus other faaji things. When dem come commot from there na to go pakurumi for after party wey go shele for Mauve Lounge for Ring Road. We still hear say all una personal OAP's on top Lagelu go full the place and the faaji go be gboa.... Oya no dull make you no carry am over O.
No comments:
Post a Comment