Some Pipu get level sha.. Who Sabi say Soul wey him real name na Dotun Amosu wey dey work for Fresh FM Sabi the Ooni of Ife. If you like radio for night, especially when na lovey lovey mata, den you go Sabi say Dotun na Oga for the levelz. And dem don sama am award for Dat category for Nigerian Broadcasters Merit Awards. Na so e put one pinshure for him instagram wey he carry him NBMA plaque go hail Ooni Adeyeye Enitan Ogunwusi, Ojaja II. Bigga Boi, I no Sabi if Oniresa Roger am something sha. Make we no forget say dem station Fresh FM win 4 awards for the last NBMA wey shele for Abuja last Saturday. Pipu wey win for the station na dem chairmo, Yinka Aiyefele plus Rolake Bello.
No comments:
Post a Comment