If una remember well, say na sometimes wey no too tey, we hear say Tungba master, Yinka Aiyefele buy new musical instruments. But Devil na Area boy, God na God father. Na yesterday we hear tori say the big trailer wey dey carry dem musical instruments go fall for Express way. Na Yinka Aiyefele himself share the mata for him Facebook page, and he just put am say the thing sad but in everything make we dey thank God. We no Sabi how the accident take happen and how pipu wey dey inside the van be but we believe dem dey okay, especially Tungba Master. We for TPN say we pray make God sama Bros more beta things and return everything wey spoil. E Pele sir. (see other pinshures after the cut)
No comments:
Post a Comment