Monday, March 28, 2016

OJORO... SEE OJORO WEY MIKEL SAY EGYPT DO FOR SUPER EAGLES

Super Eagles’ captain, John Obi Mikel din talk say the Pharaohs of Egypt no try cos dem no follow rules wey dem dey call fair play when one Super Eagles defender fall for field for Friday’s 1-1 draw for Kaduna. Na Eagles first dey lead, until when Mohamed Salah go catch one ball for we backyard when our defender Godfrey Oboabona fall for field. MIKEL say Eagles bin dey expect say make dem playback ball out but Sha O, na inside the net Salah put am after he collect the pass from Ramadan Sobhy. Captain Mikel say dem play well but dem throway many goals wey for make dem win the match. He say everybody just dey say dem list but wetin him Sabi be say fair play na fair play,  and wetin happen for the game na cheating.

No comments: