Monday, March 28, 2016

PEKELE PEKELE…SEE OJORO WEY MAKE CYMBALS DANCE GROUP DEY PARA FOR NEXT RATED STARS

                                                                                             

Na wa wa o..shebi na for time wey no too tey one mega show happen for Ibadan wey dem call NEXT RATED STARS and the show suppose find young talent for ibadan.na so members of Cymbals Dance Group wey dey rep Ibadan everywhere go collect form take compete, dem Oga Agboola Olatundun Cymbalssay na only him waka go buy forms for A.Y COUTURE wey dey Sango, Ibadan. Fromm wetin he byarn he buy form for Adetoun Cymbals wey dance for the competition and Oreoluwa Adeyemo, wey be DEX Makeover and she go do make-up for the competition. Tori yarn us say afta tuff competition, dem polongo say na Adetoun win for dance and na Oreoluwa win for makeover and dem say each of dem don win 250k. 



Tori yarn us say na afta every every wey dem don carry bpali give dem for stage and everybody don go, na him Next Rated Stars go bring dem one kain agreement, wey dem bin no mention before, make dem sign. The contract say dem go change am for dem….lol…change dem cash prize to something wey go get dat same value. The agreement still talk say dem go sign the win ners and dem abi any of dem padi must not write abi yarn anything wey be yabbis for any social media abi media platform. Olatundun Cymbals say e be like say pipu wey win for other cetegories don follow dem sign but for dem Cymbals nation, na the 250k abi make dem bone patapata cos dem no go gree make dem cheat dem. Toor….the mata be as e get, na o I go one Talent hunt too for LeadCity in 2007 wey I win 40k dat year, except if dem go pay me tomorrow. MUSE EUGENE wherever you dey God go ask you for my money ooo…….lwkmd.


No comments: