Tuesday, March 8, 2016

NAIJA PIKIN, CHINEDU HARRISON DON BREAK GUINNESS RECORD WITH BALL FOR HEAD

CRIS - Na who say Nigerian nor dey try??? Oya come see this ogbonge correct Nigeria guy wey dey play football for Cambodia Chinedu Harrison, he Don break guiness world record as d only player wey Don carry ball for head take travel longest kilometer. Chinedu carry d ball put for head come start in Waka from redemption camp wey dey for Lagos ibadan express way to National Stadium inside Lagos. When dem calcluate the distance, e be 48.04km and he Waka am within 6hrs 15 minutes. When he reach the stadium, he Waka round am with the ball for him head 22 times to take beat the record wey one Indian soldier Nabab Azad Singh before 45.64km. Bcos of this ogbonge achievement, Chinedu Don turn ambassador for naija.

No comments: