Sunday, March 27, 2016

HMMM... SEE HOW GARBA SHEHU DEY PARA ON TOP YARN SAY HE SELL FOREX




PDP on Saturday say the Senior Special Assistant to President Muhammadu Buhari on Media and Publicity, Garba Shey hammer like N280m when he dey sell some kain Internet money like Dat,  wey Oyinbo dey call forex. On top dem Twitter handle, @PdpNigeria, the party say Shehu no do am alone O,  cos Oga governor for Central Bank of Nigeria Governor, Godwin Emefiele follow am arrange the levelz.  


But sharperly the Oga megaphone to we Presido, don deny the mata. He say on top him Facebook wall on Saturday say him no dey sell forex O and na carry him go carry person wey dey send that tweet go court. He say na lie PDP lie for him head o,  na only two times he don buy forex since him join government and dem be $8,000 wey he send go give him daughter and nephews through USA,  he say if una dey doubt am you fit go check am o. He say if he wan sell forex. He go first resign from government. Meanwhile as he dey deny, na so we Presido wife too dey deny her own cos dem say she too sell forex and she happen wella.






No comments: