Thursday, March 10, 2016

ISSOKAY... SEUN AKINRINADE GO DEY WITH DEM JCI OLUYOLE DIS SUNDAY


If you dey listen to programme wey get brain well well for Radio,  and you dey stay Ibadan,  den I fit bet am say you Don hear the name, Seun Akinrinade before. The Bros na one kain person wey no dey fear, especially when he dey scatter dey gather political mata on radio. At times you go think say him na APC, sometimes e go be you like say he be PDP, but most times you go Sabi say he be free agent,  when he dey yarn in top Splash Fm. Even when Edmund Obilo no dey Dat time na him dem say make he dey run that popular programme, VOICES on radio. 
Tori still yarn us say this Bros na pastor O,  as e like political mata reach and that na why this coming Sunday, wey be13th March 2016, ‘Seun go dey for the Business/Training Meeting of JCI Oluyole, where he go dey yarn on top: The Power of Active Citizens. What will it take for JCI Oluyole to sponsor a bill? He go let us Sabi if anything dirty about make person dey do politics and who get the work make e dey monitor government. The meeting go shele for Travel House Budget Hotel by 3pm on Sunday. If you wan Sabi more about the level,  Halla dis number 08036292636.

No comments: