Sunday, March 27, 2016

GHEN GHEN... MERCY AIGBE DON VEX GO CARRY SWANKY JERRY TO DEY WEAR AM CLOTH






E be like sayMercy Aigbe don Sabi reason why dem no call her join pipu wey Sabi dress pass for the AMVCA 2016 wey shele recently.  Bcos as per say e no tey wey she para on top instagram sake of say ThisDay Style no call her name for dem last edition, Mercy Aigbe don go get person wey dey dress for dem celebrity pipu, Jeremiah Ogbodo , wey pipu Sabi as Swanky Jerry make dat one dey dress am. 


Wetin she wrote for her Instagram na say she dey work with a professional stylist for the first time and person wey she carry,  na him bad pass, na so she wrote come put pinshure wey she follow Swanky snap join,  with plenty hashtags,#workmode#workflow. Swanky Jerry bin don dress for actresses like Annie Idibia, Juliet Ibrahim, Tonto Dikeh among others.

No comments: