Sunday, March 27, 2016

CONGRATULOBIA... SEE THE POSITION WEY DEM GIVE JAIYE KUTI FOR LASPOTECH




Tori wey dey enter we hand dey clearly say popular nollywood actress, Jaiye Kuti na him dem don polongo as ambassador for Lagos State Polytechnic by the Rector of the Polytechnic, Samuel Sogunro. 

The woman wey do popular film ‘Jaiyeola Ni Monje’ bin finish from the school and dem polongo her name plus one Olanrewaju Olakanlu wey dey do Mr. and Mrs. Kogberegbe TV programme, as per say na for the school he sef for finish. Na so Sogunro yarn when the 2 pipu go hail am for office, for him byday,  wey dem still carry beta gift go give the school and hin students

No comments: