Friday, March 4, 2016

GBÉNGA ADENUGA DEY COME BACK TO IBADAN DIS SUNDAY

If you don tey small for Ibadan,  you go Sabi wetin wan shele dis Sunday. The Big Boss dey show for area after some times. This Bros wey be ogbonge gospel musician don rock Ibadan back to back,  every month before. But as life dey always be, e don Waka for good,  go make more brains for life. Now he wan show back for area dis Sunday,  6th of March for Jogor Center by 5pm. Gate free na fee abi make you re-arrange am, Gate fee na free. All him loyal boys wey he leave Dat year don turn big men wey dey move,  dey shake Ibadan. Dat na why the show no fit make anything but senses. O ma rosy!

No comments: