Monday, March 28, 2016

AFTER 21 YEARS…SEE HOW GOD TAKE IVF ANSWER FAMILY PIKIN PROBLEM FOR IBADAN

                                               
E be like film trick when the family of Mr and Mrs Akeju born dem first pikin on Wednesday, 16th March 2016. Wetin make the mata turn jubilation na sake of say dem don dey find pikin for over 21 years. Na so dem dey pray till God butter dem bread when dem open first fertility centre for Vine Branch Fertility Centre, Mokola, Ibadan in May, 2015 go do wetin oyinbo dey call IVF. Na him we dey call test tube baby, where em go sollect sperm from man, collect egg from woman inside lab, come carry the small pikin wey still be embryo inside the mama, make e dey grow. 

Na 1978 dis kain thing first happen for the full world but the thing no happen for Naija till 1989, come finally reach Ibadan in July 2015, wey dem come born the pikin for March, 2016. We just dey thank God cos na good news be that for pipu wey dey find pikin for Ibadan. The baby mama, who be 47 year-old no fit stop cry dey shout Alleluyah dey thank God as she give the pikin name ; Precious Grace Oluwasindara Akeju. 

When she dey yarn, the oga wey sabi wella about Fertility, wey still be Consultant for women mata, wey dem dey call Gynaecologist, wey lead the team wey do the IVF, Dr Oluwabukunmi Kolade of Vine Branch Fertility Centre, Mokola, Ibadan join the family to hail Baba God wey don finally bless the family with dem own. She say no be dem na God o and the dedication of dem management and staff for Vine Branch Fertility Centre, cos e dey take like 8 months before new center like dis dey fit do dis kain thing but na first time wey dem try am for there dem catch am. He say dem no dey slow down at all o, co dem don still get some tear rubber better equipment to take do beta for pipu wey dey find pikin. When he dey talk about money wey dem take dey do am for Ibadan, Dr Kolade believe say if husband and wife fit buy small Tokunbo car, dem go fit do IVF, bcos the money make sense and the result everybody sabi say na forever. We for TPN say congratulobia to the Akeju family plus Vine Branch Fertility Centre wey God send to do beta for Ibadan pipu.

No comments: