Na so e do me like say I no hear well O. When I hear tori say na last Monday wet be 22nd of dis month na him broda mi Dapo, Eje-Nla first meet person wey do beat for him latest song, Emergency wey dey burst cousin chart anyhow. Tori yarn us say na for Hip TV studio dem jam for Lag and D'Banj really happy to meet the Bros wey him name na T Loops. D'Banj say na thru OLU Maintain the guy send the beat to am and na the song D'Banj take rock am for glo caf awards when he sing the song for the first time come release am immediately, and make I famz say na one of my sure Bros, Fashie Fizzie snap the pinshure wey dem do the artwork. But Bros no too do well O, so person send you beat, you record am, release am, no even bother say you wan meet the person. I no too like Dat one sha. But all join, dem sha don meet and I dey expect anoda beta beat from dis guy, e be like say the guy get the formula wey Don Jazzy bin get.
No comments:
Post a Comment