Wednesday, February 24, 2016

SEE MONEY O... OBAFEMI MARTINS GO DEY COLLECT 6.6M POUNDS FOR HIM NEW CHINKO CLUB

Super Eagles striker Obafemi Martins, don confirm am say he don Waka commot from Seattle Sounders wey dey U.S.A go Shanghai Shenhua for China. Tori yarn us say he go dey collect dat kain $6.6 million per year after dem commot tax for him new chinko club. Martins bin dey on top $3 million per year for MLS side, Seattle
Sounders, but after he pay tax,  the thing no dey pass $2 MILLION again.
Martins don already join him new club, wey go start dem Super League season on March 5. He bin don play for Inter Milan (Italy), Levante (Spain), Wolfsburg (Germany), Newcastle United, Birmingham City (England) plus Robin Kazan (Russia).

No comments: