Sunday, February 28, 2016

FEDERAL GOVERNMENT WAN GBEGE EFCC, ICPC PLUS PENSIONS ON TOP 1. 3TRILLION NAIRA WAYO

E get some kain News wey you go see,  you go shock. Abi how we wan talk did one wey bush meat wan dey catch the hunter. Na so tori carry am today say we Federal Government for Naija go shine light for the dommot of we security dogs for Naija, EFCC, ICPC plus PENSIONS. Dem wan ask dem questions on top how dem do cash wey dem bin collect from former Bayelsa Governor dey don kpain now,  DSP Alameisigha and the money wey dem collect from former Oga patapata of police, Oga Tafa Balogun. E be like say dem no carry the money reach house, dem don .... You sabi as e dey be for Naija now. But the mata shock me sha.

No comments: