Olubadan-in-Council don write letter to Dr Alex C. Alozie make he stop to dey show himself say na him be Eze Ndigbo for Igbos wey dey Ibadan plus Oyo State. But he no gree O cos he don reply dem letter. The Olubadan letter wey Oladapo Abiodun Esq write talk say dem dey too show dem self and dey tranga the law of the Land wey fit burst kamala for the state. Another clear dem say court don tell am say na him be Eze Ndigbo O, so make nobody reason am say dem wan fall him hand. He say na some bad Belle pipu wey dey claim him title wan cos gobe. But still on still, no shaking.
No comments:
Post a Comment