Na Aluta continua yesterday O, wen some medical students for University of Lagos, Akoka dey Para say the school don Sama dem courses wey dem no ask for O, dem say if the school no do normal after 7 days na court go settle the gbege for dem. They say dem don write letter to dem Vice-Chancellor, Prof. Rahman Bello, the Federal Ministry of Education, Senate Committee on Education, National Universities Commission, Lagos State Governor, Akinwumi Ambode plus other pipu on top the Mata. The students say dem read dem life to make sure say dem pass wella for 100 Level, and dem don pass, but the school no gree give dem medicine wey dem wan do, come dey tell dem super story say na space no dey. Na wetin make dem and dem parents do Aluta go punch office yesterday go do Aluta.
No comments:
Post a Comment