Popular guy wey dey sing hip-hop for obodo Oyinbo, Kirk Franklin don talk on Twitter to pipu wey dey yab am on top say he do collabo with Kanye West wey everybody dey see like say na him be Assistant Devil. Some of him fans think say the collabo no suppose be cos Kanye no be am at all for the song wey dem never even release. When he dey talk him mind on top social media. Franklin say Kanye no be me and me no be Kanye, he be my broda and I dey proud to do life with am. He say na so pipu first dey yab am on top say dem snap pinshure together, he say make dem no vex O cos him no believe say one person dey wey bad pass Grace of God. He sha say for him O, he go dey push him broda away, he go dey pray for am and dem go grow together. Toor, make una remember dem two for your prayer O. Make person wey wan drag persin commot from fire, no come follow am fall inside.
No comments:
Post a Comment