No be small mata O, dem say if no body beat dis man again for the rest of him life, the one wey dis soldier man beat am don do am. We hear say many pipu no even see wetin happen before dem see the soldier first commot koboko take dey wire the driver wey dem call him name olaniyi. After some time na him the soldier change am to serious blow, carry the guy come down, beat am like say na him be Shekarau, Oga of Boko Haram. Na after dem beg the soldier softly he tell dem say the man bin wan take car jam am when he dey reverse am, when he come still yarn am, na yinmu the driver dey do for am. Na wetin vex am be Dat O. Na after dem beg the soldier wet he commot na him pipu start to dey yarn say wetin he do too bad, he too flog the man. When dem call soldier Oga for Lag, dem say dem go find out but that soldier man wey dem call him name Emmanuel B. J. fit be fake soldier. Na for Ojodu-Berger Area the Mata for shele, make God sha dey save us and make we too stop to dey yinmu anyhow.
No comments:
Post a Comment