Thursday, February 18, 2016

IF YOU WAN PREACH GO START CHURCH, CHARLY BOY ADVISE JULIUS AGWU FOR HIS VALENTINE SHOW

Some pipu bad O,  one of those kain pipu na Charly Boy abi na Charly Papa as e take style run Julius Agwu down for him Valentine day show,  wey he call Life as I see it wey shele for Abuja last Sunday. Charly Boy write as he dey always do about how Julius Agwu wan take preaching finish dem life for the show,  he says the 4 O clock show no start till 8:30,so dem dey expect day dem go laff die but anytime Julius climb stage, he dey change am for dem,  he say dem Com confuse for one point say abi na revival dem dey ni. He say but Boi and Akpororo make brains sha. He come advice Julius say true true him Sabi say na God save am wen he bin go do brain surgery recently but make he consider pipu wey pay money come laugh and not come hear preaching. Say make he no try Dat kain thing again O,  COS him person don dey feel like say na 419 Julius do am and him family wey he carry come. Hmmmmmm....... The Mata be as e get O.

No comments: