Thursday, February 25, 2016

JULIUS AGWU DON TAKE STYLE YAB CHARLY BOY BACK

Shebi na last week I yarn una wetin Charly Papa yarn about Julius Agwu and him show wey he do for Abuja on Valentine day wey he call 'Life As I See It'. Charlie bin write one article wey he call 'Julius Where is The Genius?'  He bin talk plenty things about how Julius wan take preaching finish dem life,  wey come make am be like say na WAYO dem do am as per say na comedy he pay for. So make e for no lost,  na him Julius carry this gonfabi pinshure put for instagram come put am say the person na Charly Boy role model. Charly never talk sha,  if he talk we go let una know as per say we Aproko no get Part 2.

No comments: