Wednesday, February 17, 2016

OLAJUMOKE DON STILL TURN MOTIVATIONAL SPEAKER O... LOBATAN!!!

Shebi na Bible na him talk am say wen God ready for us, e go be like dream. E sure me die say na like dream e dey be for Olajumoke Orisaguna,  the babe wey bin dey model for Agege Bread, I believe say you Sabi her wella. Tori yarn us say she go dey talk for first time as motivational speaker dis weekend for Transcorp Hilton hotel on Saturday February 20, 2016. Governor Olusegun Mimiko for Ondo state go come there come yarn too. She go dey talk on the topic' If na we be government'. The event na for youth make dem come talk dem mind on government and Things wey government dey do wey dey affect dem.

No comments: