Thursday, February 18, 2016

NIKE COMMOT FROM PACQUAIO BACK BCOS OF WETIN HE YARN ABOUT GAY PIPU

Pipu wey dey do sport cloth, Nike don commot from the back of boxer Manny Pacquiao bcos of wetin he yarn for one TV interview about gay pipu,  where he talk say Animal beta pass dem. The company wey dey America say dem no gbadun wetin Manny Pacquiao yarn cos anybody sabi say dem no like to dey see pipu as bad on top wetin dem like, so dem no get anything to do with the Bros again. Pacquiao who be 36 sef don dey reason how he go take retire cos he wan put body for politics for him country. When dem ask am wetin he think about gay marriage on TV5,he say even animal no dey chop yam man to man, so animal even beta pass gay pipu.

No comments: