Thursday, February 18, 2016

AREGBESOLA SAY DOCTORS WE DEY STRIKE FOR OSUN STATE NA SELFISH PIPU


Rauf Aregbesola,  Governor for Osun State don describe dem doctors wetin dey strike as selfish pipu,  wey no sabi pass dem self and dem Belle,  dem no even wan know wetin happen to any other persin and dem see say things get as e be now for Naija. Na wen he go commission some tear rubber equipment for Boripe Local
Government Health Centres wey dey Boripe Local Government Secretariat for Iragbiji. Aregbesola say make dem try reason as things be for the state make dem try make sacrifices like every other persin for the state wey no see salary collect still dey go work.  He say since July 2013, the money wey federal government dey Roger dem just dey drop, even now some state no dey see any collect again.

No comments: