Thursday, February 25, 2016

NA LOVE BE DIS, ABI NA RESPECT? BADOO AND DAVIDO DEY TOTORI EACHOTHER ON TWITTER

I no Sabi as e dey go again O. For dis time wey musicians dey beef eachother anyhow, na him Olamide Badoo and O. B. O. dey totori each other for public place,  wey be Twitter,  dey romance each other ego. Na so Olamide dey yarn DAVIDO say he dey cut salute for him hustle O,  COS if some pipu Papa get money like DAVIDO Papa ni,  dem for no hustle. Na so DAVIDO too come treason am say respect is reciprocal,  na so him too hail am say Badoo na Legend. Me dey like dis kain thing sha,  e dey make brain.

No comments: