MTN don commot dem mata against Nigerian Communications Commission (NCC) from court and dem don Roger us N50 billion from the N780 billion wey we fine dem. NCC bin don fine them N1.04 trillion on top say dem no gree cut dem 5.1 million SIM cards wey no gree register. After plenty abeg, dem reduce am to N780 billion. Na so MTN too vex carry dem go court on Dec 31, 2015. But tori dey yarn us now say MTN don drop N50bn for federal government, say make dem calm down, so dem go fit settle am jejely. Dem MTN Oga patapata for Naija, Ferdi Moorman say everything dey make sense and na beta development wey go do well for the 2 both of dem.

No comments:
Post a Comment