Our money for Naija don dey show himself for parallel market O, bcos before market close yesterday, Wednesday 24th, Naira don become N240 per dollar. Na him be say na 70 Naira our money take climb up within 24hrs. But Sha O, the official Central Bank of Nigeria rate still dey for 197. Tori yarn us say na bcos say him big bros like dollars, pounds plus euros dey fall for market. We presido still dey on him point sha say he no go fall the hand of Naira.... Toor, make God sha dey save us. Now we go Sabi maybe dem go reduce price of things too, for all those pipu wey dey increase dem price becos dollar increase before.

No comments:
Post a Comment