Thursday, February 25, 2016

IBADAN CELEBS GO ENTER FIELD TOMORROW FRIDAY FOR PETERU CHARITY FOOTBALL MATCH

Tomorrow,  Friday 26th of March go tuff for Ibadan bcos all the Celebs wey dey Ibadan go enter field go show dem football skills for the Celebrity football match wey start last year. Na the match,  Ibadan popular Comedian plus OAP peteru take dey celebrate him byday. This year match go be campaign against domestic violence  and the two sides wey go play na comedians plus OAP's VS Artistes plus Dr's and na for Adamasingba Stadium e go for happen dis year by 3pm. So make una come see una celebs as dem go dey show dem self, dey fool dem sef join. Na Dat time you go Sabi say football no be by mouth for viewing center. Lol

No comments: