Sunday, February 28, 2016

GLO SAY NA LIE DEM NEVA DROP P-SQUARE O, DEM STILL DEY REASON AM

Toor... Globacom don yarn o,  dem say na rumour be all the tori wey dey waka anyhow since last week say dem don commotbfrom the back of P-Square. Dem say na true,  Peter of P-Square  yab dem officials for the final of him show wey dem call Dance with Peter. And when dem chairmo Mike Adenuga here he vex gan,  but dem never drop dem sha. Dem still dey see who and who dem wan drop cos no be only P-Square don mis-do wey be dem ambassador. So dem still dey reason am ni. Toor....we dey wait for una! 

No comments: