Wednesday, February 24, 2016

SEE GBEGE O... UAE POLICE CATCH MAN BCOS HE PUT FIRE FOR HIM OWN CAR

Na WA for dis pipu O, POLICE don catch one 23-year-old man on top say he put fore for him car for himself by himself. Tori yarn us say Dibba police get gist around dat kain 5:30pm on Tuesday, February 23 say one Mercedes Benz dey burn for Al Wurayah area, United Arab Emirates.
After den kill the fire,  dem come see say na person wey get am put fire for him own car. Na so dem catch am,  carry am go court say he take fire pafuka property wey Oyinbo dey call arson, dem still say he dey take dem country security and stability play and police say dem no go gree for Dat kain yeye thing lailai. Na WA again O.... I trust my Naija pipu.

No comments: