Sunday, February 28, 2016

ALLELUYAH... GOD SAVE TERRY G FROM ANOTHER ACCIDENT

God pass dem o, dem try kill am but don save our ginger man, Terry G from another terrible accident, cos him car get one kain strong accident dis morning around 6am for Lagos. The bad thing shele when bros dey come back from one night club between 1st and 2nd roundabout for Lekki. Tori yarn us say him Range Rover Sport pafuka completely. Make we no forget say Apako master don first get dat kain accident 5 years ago when him Toyota Camry get accident around Chemiron, close to Sunday Market, for Ogba, Lagos. The good news be say ginger man still dey kampe, no be him drive sef, and the person wey drive just woundjure small. But the range rover don pafuka sha.

No comments: