Sunday, February 28, 2016

GBOLAGA!... PRESIDO SAY HE NO READY TO PAY 5K TO PIPU WEY NO GET WORK.

President, Muhammadu Buhari don talk say him no dey give 5k monthly roger to Naija youths wey no get work. Na for one meeting wey he do for Saudi Arabia, Baba for talk him mind,  say wetin dey him own mind pass make he dey roger 5k. He say instead make he do dat,  he go do beta things for school wey need beta things, sama dem beta things for agriculture, mining like dat like dat. He say if he do dat one everybody wey wan work go fit see work do,  instead make he come dey carry money give pipu wey no wan work.

No comments: