Thursday, November 19, 2015

UI GO SHAKE TOMORROW, 20TH NOVEMBER WITH SAY D TRUTH SHOW 'ROAD TO STARDOM'

One of the few comedians wey remain for UI and wey dey make sense wella for inside and outside the campus, Say D Truth, wey him Papa and Mama bin name am Temitayo Awoniyi wan scatter UI tomorrow with him comedy show, wey he call Road to Stardom. The show na tomorrow, Friday 20th November for inside Large Lecture Theater wey dey Faculty of Arts and na 3pm dem go start. Student pass na just 2h abi 5h, accorfing to as you take get levels. Plenty comedians wey go join the man on the road to stardom na Shairman, Solid, Thompson Lawyer, Lopesito, Peteru, Diouf, 13th Disciple, Blood Pressure, Dr. Frick, Olympia, Rappindaddy, G Jokes, 2 Talk, Professor Apple plus plenty other pipu and musicians. So no rob yourself of dis faajo cos of just 2H o.

No comments: