Make Baba God sha dey bless persin, no be small mata o, if you see the plenty car wey follow Prince Ogunwusi wey oracle don collabo with government pick say na him be the new Ooni of Ife, you go bow. Tori yarn TPN say na like 100 cars follow am enter Ile-Ife yesterday plus including we former presido for naija, Baba Obasanjo and some white cap oloye from Lagos. plenty pipu come road come show the new king love, we even hear say dem jubilate so tey one of dem kpain. The Ooni go soon start all the papparazzi wey dem dey do before dem come put crown for him head say na him be the number 51 Ooni of Ile-ife.

No comments:
Post a Comment