Monday, October 19, 2015

PEKELE PEKELE...SOME PIPU FOR LINDA IKEJI BLOG SAY DEXTERITY PLUS NA GAY...LOBATAN!

Shebi dem dey talk am say na persin wey cook dey call pipu make dem come help am chop am. Na so e be for Celebrity Event Decorator, wey everybody sabi as Dexterity Plus. As things dey ginger say he wan celebrate 10 years wey him don dey the game, na so he carry him parry news put for the popular blog Linda ikeji blog where some bad mouth pipu plenty. Na so one of dem wey no gree put him name say Favour the oga of Dexterity Plus wey be Dexterity himself na gay, cos he bin dey chase am when he dey UI. As if dat one no reach na so another one too say the bros na gay come still bad mouth am join. But sha as life be as some few pipu bad mouth the bros, na so plenty other pipu dey hail am dey help am thank God cos 10years no be small thing.

No comments: