Sunday, October 18, 2015
CONGRATULOBIA TO INSPIRATION FM, DEM WIN AWARD SAY NA DEM DEY YARN BETA PASS
No be small mata o, for this time wey radio station just dey show face anyhow, na every station dey find how dem go take beta pass the other one, na him make many of dem dey plan, dey sign player dey go different things to take pass dem rivals. Na him make inspiration FM 100.5 happy wen dem sama dem award as the station wey dey yarn beta pass, wey oyinbo dey call "most informative station". Na so dem climb on top facebook go hype dem self say e never reach 6 months wey dem come o and dem don start to dey win awards, but dem no yarn us who or when dem give us the award.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment