![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Monday, October 19, 2015
LINDA IKEJI DON DO OFOFO PLUS TAAFIA TAKE BUY HOUSE FOR BANANA ISLAND
Make you siddon for there dey do ofofo wey no dey pay o, popular and infact number 1 blogger for Naija, Linda Ikeji yaff vex finish. When I first hear am I think say na Super Story until she come carry am put for inside her blog gangan. I no go lie, the thing shock me, according to her the house na almost half a Billion Naira....you too see say no be small mata. The house according to wetin she write get 6 bedroom wey get him own toilet and bathroom plus one badt bedroom wey big like stadium, get wardrobe wey dem dey waka enter, 2 parlour, media room, Cinema room, laundary room, gym room, kitchen wey full die, boys quarters, swimming pool, water fall wall, changing room, cubana etc. Toor...na so the mata reach o, so all of una wey dey do aristo/olosho make una continuu o...before you go fit buy dis kain house you go don runs a full country. Lol. If you wan see the rest pinshure go on top www.lindaikeji.blogspot.com
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment