Thursday, October 29, 2015

OMO'YA SHINA FOR SPACE FM DON POLONGO SAY NA DEC 6 HE GO LAUNCH HIM ALBUM

Popular Yoruba presenter for Ibadan wey dey work for Space Fm 90.1 don polongo o, say make all of us come hear o. From time wey no too tey na him he yarn us say make we dey expect him album, but now he don polongo again say the album don dey cook finish and na for December 6 he go launch the mata for Mauve 21 wey dey Ring Road for Ibadan. According to the bros pipu wey follow am sing for inside the album na Femo Lancaster, Femi Solar, Taiye Currency, Paso Poly, Da Prof, Mikooka plus Yoboro. Other beta musician wey go show demself for the album launch na Rasheed Ayinde, Taiwo Omotunde, Yinka Ayefele, Wale Thompson, Abass Akande Obesere Mega 99, Dele Bravo, Yinka James, Siju Harmony, Bukola Akinade Senwele, Bisi Alawiye plus plenty other pipu. If you wan sabi how the mata go take run, halla Abaslaa on 08072857052. We dey wait o.

No comments: