
Wednesday, September 30, 2015
HONOURABLE WEY GET SWAG, SEE AS DAPO LAM DENGE POSE FOR HOUSE OF REP
Who yarn you say Ibadan pipu no sabi beta fashion. Make una see for una self na, as we Honourable dey shine pass for the House Chamber. Wen I see that him pinshure for facebook, I say see our fine boy, young blood honourable o. Make we hail am wella cos the bros dey try, e sha don commission somtins take mark 100 days for office. But as we dey hail am make we dey remind am to balance everytin o, make fine boy pose, no go plenty pass the goody goody of democracy wey him go dey carry give us. As long as he no dey dull us, make he dey pose dey go, we dey for him side like shadow and we dey monitor am like monitoring spirit...lol.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment