Tuesday, September 8, 2015

TRAILERS DON TURN VAMPIRE FOR LAGOS O, NA NIGHT DEM GO DEY WAKA NOW


Winsh cry yesterday pikin kpain today, who no know say na the winch kill the pikin chop. Cos of the yeye trailer accidents wey shele for Lasgidi last week. Dem state government yesterday follow trailer pipu do meeting say trailers no go dey waka for oju momo again o, say na for nite dem go dey waka now.  No trailer go dey waka for Lasgidi from 6 for morning come reach 9 for nite. Anybody wey try am go pay big fine for government. Shey una don hear?

No comments: