Sunday, September 13, 2015
NA CHANGE DEY RULE SO K1 de ULTIMATE DON CHANGE HIM MANAGER
King Wasiu Ayinde Marshal, the Oluaye of fuji and Oluomo of Lagos don still change the persin wey dey manage am. According to wetin Nigerian Entertainment Today (NET) yarn dem say the new manager, Afiz Karim no be JJC o, him don dey follow Alhaji waka for like 20years now, him first be PA, later he turn band manager and now him don graduate to Baba Manager. He dey take over from Adebayo Olasoju who turn manager wen Percy Ademokun commot. Tori yarn us say dem don transfer Adebayo Olasoju to where him go for manage K1 political somtin.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment