Tuesday, September 15, 2015

IF NA PLAY MAKE DEM STOP AM O, LA CASERA SACK 700 WORKERS.

Na which kain yeye play be dis na, how one company go talk say dem no do again make 700 workers dey go home, na so e easy? Pipu wey dey work for La Casera office wey dey Amuwo Odofin Industrial Estate, for Mile 2 just reach office yesterday see one kain yeye notice wey dem paste on top the company gate wey dem don lock. The notice say erm...na so some pipu take come and cos gbege, so dem no fit guarantee workers safety again. so make dem dey go...Allah ba mu sah! NLC don talk say the company wey be say na indians get am dey try catch us slave for we own dommot and dat one no go dey posibu. So dem no go rest o, till dem take back the workers wey dem don put for oh God!

No comments: