Wednesday, September 30, 2015

BETA PIKIN, OBAGOAL DON SCATTER USA GOAL RECORD AS HE DON SCORE 5 GOALS FOR 5 GAMES

Na only God sabi the kain juju wey dey worry our footballers once dem show for Naija come play for Super Eagles, dem go just dey play like woman wey get belle. No be bomb Obafemi dey bomb wen he dey Naija, now the guy don go USA dey play for one kain club MLS and now he don break dem goal scoring record, as he dey score at least one goal for the last 5 matches wey he don play for dem. The only persin wey don ever do dat kain thing before na one portugese striker, Freddy Montero but as dat one don retire Obafemi get chance to scatter the record patapata if he score another goal for the match wey dem get on Monday. So make una dey pray for broda Femi o, bcos say na we pikin as he still dey claim 30 years old. Lol.

No comments: